Ghana Soccer | League Sunday | England League | League Fantasy | Spain League | Italy League | Nigeria League | Germany League | Football | Soccer | Ghana Soccernet

single

DR Congo coach Le Roy don kari cunny come against Ghana for AFCON (Pidgin English)

Posted On Tuesday, 18th December 2012
Africa Nations Cup paale, Claude Le Roy, don tok say e go hard make Democratic Republic of Congo (No, no be that yarinya wey dey my street. Dis one na different “Congo”) carri first for South Africa nes month.

Le Roy say he no go fit beat Ghana

Africa Nations Cup paale, Claude Le Roy, don tok say e go hard make Democratic Republic of Congo (No, no be that yarinya wey dey my street. Dis one na different “Congo”) carri first for South Africa nes month.

 

Le Roy sabi wetin he dey tok sake of say he been don carri Cameroon take first tay tay (for 1988), come follow take Ghana carri 3rd for Accra sef for 2008. (Yes, na dat one wey Junior Agogo been waya beta goal, de time wen dem bilala our Paale Eagles. E still dey pain me)

Le Roy been dey yarn all dis as contri people ask am whether Congo fit carri first, on Monday.

“Carri first ke?! E go hard us o!”

Le Roy been don coach Syria befor (2011) but he no tay for dia; na only 2 months he been train dem befor he revise come back Congo (Dis Congo na DRC o!) for part 2. (Yes, he don be coachi for Congo befor. Una no say Congo full dat side na)

Congo team waka comot Kinshasa on Monday, becos dem wan land berekete for Port Elizabeth, inside South Africa, to prepia wella.

As dem dey waka, Le Roy tok say, “We wan carri 41 playas for 23 shirt”

“Na only playa wey sabi tap ball I go give shirt.”

“Any playa wey feel say he sabi, na im chance be dis.”

“I no be fada Chrismas.”

Le Roy dem go play for Group B and dem go play hin former boys, Ghana (na small remain wey don no reach final for 2012), Mali (our own coachi former boys) and Niger.

Una rememba say Nations Cup dey start for January 19 and e go finish for February 10.

Source: SuperSport

Related Images



READERS COMMENTS

  1. GH FUO, THINK BIG!!! says:

    AA SHOULD HVE PICKED AQUAH OVER DEREK BOATENG. OF ALL THE PLAYERS AA SELECTED, DEREK IS THE ONE WHO IS THE MOST BENCH WARMER AT HIS CLUB. TAKASHI BALL NKOAAA. NO SENSE!

  2. Jonny penis ( JP ) says:

    Rubbish. write good english and stop this pigin thing.

  3. kuukuphilly says:

    So wetin u want make we do?

  4. Chu says:

    Na dis be de best i eva read 4 dis site. u 4 write all articles for pg sekof e for turn international. una write am more

  5. Papa Nkrumah says:

    O come on. Just have a laugh!!! lol

  6. Apong says:

    He’s a good tactician though!!!

  7. Dr Who says:

    Na true ooo!…Ghana may not have a fantastic team but Ghana no be easy to beat.





Click Here For All Latest football news.

Live Radio

http://ghanasoccernet.com/new/images/banners/onair.gif 

Live TV

http://ghanasoccernet.com/new/images/banners/onair.gif

Get the Flash Player to see the wordTube Media Player.

RELATED NEWS

LATEST HEADLINES

It was a disgrace to lose 6-1 to Nigeria - ex Ghana defender Sammy Kuffour thumbnail

It was a disgrace to lose 6-1 to Nigeria - ex Ghana defender Sammy Kuffour

Sammy Kuffour says it was a huge disgrace for Ghana's U17 team to lose 6-1 to Nigeria at the African Junior Championships.
Ghana FA confirms friendly against Kenya in Nairobi in June thumbnail

Ghana FA confirms friendly against Kenya in Nairobi in June

The Ghana FA has confirmed the Black Stars will play Kenya's Harambee Stars in June as a preparatory match for two 2014 FIFA World Cup qualifiers in the same month.
Ex-Nigeria FA chief Kojo Williams tips Super Eagles to flop at Confederations Cup thumbnail

Ex-Nigeria FA chief Kojo Williams tips Super Eagles to flop at Confederations Cup

Former NFA Chairman, Kojo Williams tells JOHN EGBOKHAN that the Super Eagles have little chances of doing well at the forthcoming FIFA Confederations Cup in Brazil. He also speaks on other trending football issues.
Airtel launches season III of Rising Stars competition thumbnail

Airtel launches season III of Rising Stars competition

Season III of the Airtel Rising Stars competition will kick off on May 31st following the official launch of the juvenile contest on Friday.
Ghana coach Kwesi Appiah ranked 69th world best coach - beats Van Gaal, Domenech thumbnail

Ghana coach Kwesi Appiah ranked 69th world best coach - beats Van Gaal, Domenech

Ghana coach Kwesi Appiah has been ranked the 69th best coach in the world surpassing world acclaimed coaches like Louis Van Gaal and Raymond Domenech.
Ghana striker Asamoah Gyan claims he was misquoted over Europe return thumbnail

Ghana striker Asamoah Gyan claims he was misquoted over Europe return

Asamoah Gyan maintains he is committed to his contract with Al Ain and has no intention of quitting the runaway UAE champions this summer.

LATEST HEADLINES

Categories