DR Congo coach Le Roy don kari cunny come against Ghana for AFCON (Pidgin English)

Published on: 18 December 2012

Africa Nations Cup paale, Claude Le Roy, don tok say e go hard make Democratic Republic of Congo (No, no be that yarinya wey dey my street. Dis one na different “Congo”) carri first for South Africa nes month.

 

Le Roy sabi wetin he dey tok sake of say he been don carri Cameroon take first tay tay (for 1988), come follow take Ghana carri 3rd for Accra sef for 2008. (Yes, na dat one wey Junior Agogo been waya beta goal, de time wen dem bilala our Paale Eagles. E still dey pain me)

Le Roy been dey yarn all dis as contri people ask am whether Congo fit carri first, on Monday.

“Carri first ke?! E go hard us o!”

Le Roy been don coach Syria befor (2011) but he no tay for dia; na only 2 months he been train dem befor he revise come back Congo (Dis Congo na DRC o!) for part 2. (Yes, he don be coachi for Congo befor. Una no say Congo full dat side na)

Congo team waka comot Kinshasa on Monday, becos dem wan land berekete for Port Elizabeth, inside South Africa, to prepia wella.

As dem dey waka, Le Roy tok say, “We wan carri 41 playas for 23 shirt”

“Na only playa wey sabi tap ball I go give shirt.”

“Any playa wey feel say he sabi, na im chance be dis.”

“I no be fada Chrismas.”

Le Roy dem go play for Group B and dem go play hin former boys, Ghana (na small remain wey don no reach final for 2012), Mali (our own coachi former boys) and Niger.

Una rememba say Nations Cup dey start for January 19 and e go finish for February 10.

Source: SuperSport

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more