Pidgin English: Caf don ask ojoro referee to kommot

Published on: 08 February 2013

Caf wey na dem dey control futball for Africa don vex ban Tunisian refiree wey be Slim Jdidi becos of de wayo and rigimo wey hin do for de semifinal game betwin Burkina Faso and Ghana on Wednesday.

Hicham El Amrani wey be Caf general seketry tok say Caf no dey happi at all with de magomago wey Jdidi take refiree de game.

“We don tell am say make im carry hin bag kommot for here as we don suspend am becos we no expect de kind level wey him take handle dat game,” Naso Amrani tok.

Among de katakata wey de refiree do Burkina Faso on Wednesday for Nelspruit na de red card wey him carry dash Jonathan Pitroipa and de guyman fit no play for de final against de Supa Eagus of Naija on Sunday.

Na dis Friday na im de organising committee dem go decide weda make dem allow Jonathan make im play de final against Naija Supa Eagus or make him sit down dey pray for bench.

Meanwhile, Burkina Faso don appeal, but El Amrani yarn say de onli thin wey go make Jonathan no miss 1game na if Jdidi wey be de refiree write for im report dat him make mistake for dat semifinal game.

“If de refiree fit write for de report wey hin go submit give us dat him make mistake, den de committee go consida and make dia decision but na de report be de final.”

Upon all de wayo wey de refiree do, Burkina Faso still win de game 3-2 against Ghana on PK.

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more