Pidgin English: Ghana don reach Nations Cup semi final, Wakaso bi chairman

Published on: 03 February 2013

De Black Stars of Ghana don become de fess team wey go waka reach de semi final of de ogbonge 2013 African Nations cup wey dey go on for South Africa.

Na Cape Verde na im Ghana take reach de semis as dem waya dem 2-0 on Saturday for de stadium wey dey Port Elizabeth.

Mubarak Wakeso na im be de chairman for Ghana as na de two goals wey de guyman score carry de Black Stars reach de lass 4.

Cape Verde wey na dia fess Afcon show be dis try well well as dem don promise dia pipu and fans to waka pass de kwatafinal, but water kon pass gari on Saturday as Ghana no gree for dem.

Walahi, Cape Verde carri plenti swagga take start de game and na dem even get de best chance to score for de 17th minute, but Heldon Ramos troway am.

Na with pride na im Cape Verde go carri dia load kommot jeje for South Africa as na everybodi know say dem try for de 2013 Afcon.

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more