Pidgin English: Ghana take Tunisia drink 'garri'

Published on: 14 January 2013

Na 'play-play' match e be. Ghana and Tunisia dey prepia for Nations Cup, so dem play diasef for inside Abu Dhabi. Everitin hapin for second haf. Ghana coachi, Kwesi Appiah, enta inside dressing room wit hin playas afta fess haf finish. Weda he gbege dem, or he yab dem; de tin work well, well. Ghana comot for second haf wit anoda mind.

Ghana tia Tunisia net 4 tines for second haf, after Tunisia bin dey waya dem 2-kondo, as dem waya Tunisia 4-2 for inside the Sheikh Zayed Sports City stadium for Abu Dhabi.

Issam Jemaa bin don score two goals, before Kwesi Appiah change Ghana style. Ghana playa, John Boye, start de gbege for Tunisia wen he head Mubarak Wakaso freekick inside net.

The goal bin remind many pipu of Emmanuel Agyemang-Badu goal, wen Ghana waya Egypt for anoda 'play-play' match. Na Wakaso bin nasa freekick dat time too.

Wakaso come waya beta penarity, afta Tunisia bin foul Christian Atsu inside box 18. scores come be 2-2.

Asamoah Gyan, na from bench de coachi bring am, come score Ghana numba three goal, bifor Albert Adomah, anoda playa wey come from bench, come score to make scores 4-2.

Ghana (na Black Stars be dia guyname) bin dey play dia las 'play-play' match bifor Nations Cup go start on Saturday, and dia coachi, Kwesi Appiah, leave Solomon Asante and Kwadwo Asamoah for de team. Isaac Vorsah bin get one kin muscle pull bifor match start, so de coachi kukuma put John Boye inside.

Stadium bin empty like some Naija politician head, sake of say de pipu wey organise de match say dem dey fear make sontin no hapin. Dem no yarn us wetin for fit hapin sha.

Richmond Boakye Yiadom start de match as Ghana numba 9, and Christian Atsu bin dey support am for back. Kwadwo Asamoah play for lef side of defence. Solomon Asante bin dey show beta skill but de guyman too dey fall. Many pipu dey wonder how hin go do if he come play contri wey get strong playa dem.

Tunisia start de match like say dem dey vex, as dem control midfild and dia wingers dey play fire. Dem come score afta Issam Jemaa waya net, even tho Msakni and Rabiu Mohammed bin jam demsef, fall, yakata, for ground.

Ghana bin dey wait make refree blow wisu, but Darragi carri ball, lob am for Jemaa. Jemaa run pass Boye come score. Tunisia come dey lead 1-0.

Tunisia come dey holo de midfild, and Ghana coachi come kukuma remove rabiu Mohammed, as de guyman no bin dey play well, put Emmanuel Agyemang-Badu instead.

Wen haf time reach, Tunisia dey lead Ghana and many guymen dey wonder how Ghana wan score sef, as na Tunisia bin dey holo de midfild.

As second haf start, Wakaso colet beta pass from Asamoah. Instead make he pass to Yiadom, de bobo shoot over de bar! Yiadom vex well, well.

E no too tay bifor Isaam Jemaa score hin second goal for Tunisia (na him don score goal pass for de contri sef), as Ghana goalie, Kwarasey, no look de shot well, come let am pass hin hand. 2-kondo.

Ghana coachi, Kwesi Appiah, change de game sharp, sharp. Asamoah Gyan enta for Richmond Boakye-Yiadom and na so game come change.,/p>

Many guymen for Ghana don dey tok anyhow, as per, how Ghana fit win Nations Cup, and dis win wey dem get for Tunisia head suppose make all man cool down small.

Ghana go start dia Nations Cup on Sunday, wen dem go play DR Congo for Port5 Elizabeth, inside South Africa.

Source: SuperSport.com

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more