Pidgin English: Wata pass garri for Tiote

Published on: 15 February 2013

Newcastle United and Ivory Coast midfilda Cheick Tiote don emta kasala with Queen ekelebe for England dia as dem don arrest am, as per say dem dey suspect say in do fraud. Media pipu bin repot say, Tiote wey juss kom bak Engalnd dis month afta in play for Ivory Coast for the African Cup of Nations wey juss finish, dey wahala as dem don seize in car.

" Around dat kain 1.30 pm for Februari 12, we bin stop one car for Benton Park Road, for Newcastle and we don arress one man wey b 26 years as per we dey suspec say in do fraud as per wetin concern driving." Olopa for Northumbria tok for Wednesday.

Wahala fit dey for Newcastle if the no nonsense Tiote no go fit play, dem dey numba 16 for table, and na onli four point take separte dem from relegashun mata.

But good news come dey small for Alan Pardew boys, the manaja sef tok say dia France strika Yoann Gouffran suppose come training ness week afta the leg injuri wey in get for the 2-1 wey Tottenham beat dem lass Saturday so.

Na for strecha dem cari am comot afta in score in fess gol for Premier League, dokitas sef been fear say in don break the leg, but as dem come do test leta, e come shoe say e no too serious like dat.

" The good news don shele b dat, we bilif say in go train for Monday" Pardew tell the klub website

"That's all good news, fortunately. We think he'll train on Monday," Pardew told the club website

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more