Time don reach! - Nigerian writer laments in pidgin English

Published on: 11 December 2011

Contri People, wetin dey do some of our players sef? wetin make dem dey do tumbo tumbo before dem answer us.

Especially that our brother, the son of Michael Obi wey him real name na John Michael Obi but him guy name na Mikel

No be him say him back dey pain am when dem say make him come play ball for when Super Eagles follow Botswana and Zambia play international match the other week, but when e reach Chelsea and Liverpool match last weekend ,him balance ,back no pain am again.

No be only am oh! Even Obinna Nsofor wey him Oyibo name na Victor Obinna too, na de same tori, whether na leg abi na waist him say dey pain am, but e no pain am last weekend when him too show for Lokomotiv people match for Russia.Di oda time sef , Osaze Odemwingie wey Oyibo dey call Peter Odemwingie say him no fit play for naija against Ghana sake of say him dey go do operation but de next week, na for West Brom him de kampe even score goal join.

Why dem dey behavior like this? So my people ,time don reach wey we go begin to do somthin!

We need to look for player wey ready to show face even before dem call dem. Manay of de player wey we get now for Super Eagles dem no de take de ball serious anymore. Why we dey beg dem? Why we dey call dem? Na only dem dey? Make we shine eye well well.

Na story story we dey always talk about our players for 1992, 1994,1996,1998,2000. Dem been sabi play ball well and dem been get ogbonge coach, Clemens Westerhof wey we need to look dat time wetin him been do.

We don forget how him been start. When him start work, him first come look de team the day when naija play Angola for national Stadium for Lagos, dat time we get plenty player wey been ready to die for naija. Na dat day wey Sam Okwaraji sef die .make him soul rest in peace.

Nobodi say make players die for field but at least dem go play with dem mind, dem must know say na naija flag dem dey carry, when dem sing de national song, dem must mean am.

For Westerhof, first match wey we play Cameroon for dat 1989 for qualify for World cup ,Italia 90, na Cameroon win us I Zero but also our goal keeper wey be David Ngodigha, dem rush am go hospital.

Dat time and many year before then our player dem no dey take the thing play.The wan time wey Westerhof say make the players wey dey Obodo Oyibo come play for nation cup 90, dem dey do yanga, na him Westerhof go waka all over naija come call boys for iwuanyanwu nationale, ranchers bees, rangers and everywhere for naija

Na so Uche Okechukwu, Friday Elaho, Daniel Amokachi, Herbert Anijekwu, Benedict ugwu, Emma Okocha( Jay-Jay Okocha senior Brother),even Rashidi Yekini never go Obodo oyibo dat time, na for Ivory Coast him de. Abi no be so?

Una don forget say na only home boys him carry go reach de finals for Algeria 90? Even though Algeria first knack us 5 kpondo for opening match, no be de boys fight till na sweat Algeria take win us only 1 zero. All the Boys wey come become the Ogbonge Super Eagles, no be for inside Naija dem find dem. Finidi George, Emmanuel Amuneke, Nwankwo Kanu, Taribo West, Ben Iroha, Thomson Oliha, Garba Lawal ,how many I wan call.

Na so, oyinbo come see dem carry go obodo oyibo, wey come make dem kuku sabi play more, then dem come strong kakaraka.

So, I dey beg Keshi, beg NFF join, most of this player wey una dey beg like Mikel, e don do!

Make una go look inside Naija League. Look well well go University or polytechnic, if una fit look everywhere reach even Agenebode and Damaturu and every town, village or township. As We plenty reach for Naija, na so player boku. Make una no tell me say una no go fit see players. If not, how e be say only Ahmed Musa now wan divide himself reach 100 places. Only am dey play U20, Play U23, Play Super Eagles. If no be say e get as e be, maybe dem for carry am go play for Super Falcons.

The same Ahmed Musa been dey play for Kano Pillars, na only one year since him go Obodo oyibo, so if we fit take time with the players wey we fit find,dem go fit strong well well. As e be say we don land for ground well well.Dis na de best time to find dem.

All did player wey don dey play for Obodo Oyibo wey some dey do shakara join yet we never hear say Real Madrid and Manchester City and Manchester United wan buy dem or even pay big money for dem head no go fit helep us. Dem never fit. Na de same players wey no fit qualify for Germany 2006 world cup, na dem struggle to reach South Africa 2010, na de same people wey no fit even reach nations cup yet we no go hear something.

Anybodi wey no happy to wear our cloth no good for us. Players boku for inside naija. Before before na for inside University of Lagos dem find Adokiye Amiesimaka, dat time him dey study Lawyer but We no dey look.

As for Mikel, and oda players like am, no be by force. If una no wan play, we no dey vex, make una kuku talk so, no be when una need oyinbo paper, dat time una go dey find way make dem call una for Super Eagles.

Na Fela Anikulapo-Kuti wey sing say " Soldier go, Soldier come. "

Time don reach make we make plan , look tomorrow well well, even if e go take us 5 years.

Time don reach make we find people wey ready to join our footibol Army and fight like soldja.

Time don reach wey we go shun anybody wey no ready to work for our country. Wetin una think oh!

By: Emeka Enyadike, SuperSport

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more